Why Japan name Kisarazu as di hometown for Nigerians and which visa dem wan give dem

Foto of di acting acting ambassador of Nigeria to Japan, Mrs. Florence Akinyemi and Yoshikuni Watanabe, di mayor of Kisarazu, as im present di certificate from diJapanese government naming Kisarazu as di hometown of Nigerians.

Wia dis foto come from, @FMINONigeria/X

Japanese govment don designate Kisarazu city as di hometown for Nigerians wey wan live and work for Japan.

Nigeria Ministry of Information and National Orientation wey give di informate on dia X handle on Friday 22 August say dis na efforts to deepen cultural diplomacy, promote economic growth and enhance workforce productivity.

According to di ministry, na for di sidelines of di 9th Tokyo International Conference for African Development, dem announce dis initiative.

Dem say di Japanese govment go create special visa category for highly skilled, innovative, and talented young Nigerians wey wan go Kisarazu to live and work.

About di 123 million pipo wey dey live for Japan, na only 136,000 dey live for Kisarazu becos of di aging population.

To benefit from di opportunities, you go need apply through di website of Embassy of Japan for Nigeria for di "hometown" visa.

Pipo go also need to learn about di Japanese culture and understand dia language becos no be all of dem dey communicate in English.

Japanese govment dey offer foreigners wit affordable housing under di scheme, dem go fit work and operate dia businesses freely for di city.

Nigerians fit migrate wit dia family members and register under di Japan health insurance system to benefit from di kontri medical services just like di locals.

For di success of di scheme, di govment go support families wit children, especially interracial couples wey marry indigenous Japanese pipo.

In di case of study and career, you go need register wit di govment as student or skilled professional. If you wan work as student, you fit work but wit di permission of di Japanese govment, dat one na 28 hours during school period and 40 hours during holidays.

As for highly skilled professionals in di health, art, education, technology and social-science industry. You go need apply for job bifor you enta into Japan wit your family and declare your monthly income to di govment so you go fit sponsor yoursef and family while living in di kontri.

For pipo wey get interest in skilled-work and blue collar jobs, Japanese govment don heavily invest in di agricultural sector to help di industry thrive so pipo go get access to food. Di govment also get interest in di fashion and entertainment industry wia young pipo wey dey study fit also look into dis as side hustle.

Who go benefit from di special visa dispensation?

Tourist couple dey waka for shirine as dem wear kimonos and carry umbrellas.

Wia dis foto come from, Susumu Yoshioka/Getty Images

Artisans and oda blue-collar workers from Nigeria wey dey ready to upskill go also benefit from di special dispensation visa to work for Japan.

Japan International Cooperation Agency, for one ceremony, also name di cities of Nagai for Yamagata Prefecture di hometown of Tanzania, Sanjo for Niigata Prefecture di hometown of Ghana, and Imabari for Ehime Prefecture di hometown of Mozambique.

Through di arrangement, Japan look to strengthen exchanges wit di four African kontris by officially connecting municipalities wit existing relations wit dose nations, according to di Nigeria Minister of Information.

"Nigeria Charge d'Affaires, Mrs. Florence Akinyemi Adeseke, also di Acting Ambassador to Japan, and Yoshikuni Watanabe, di Mayor of Kisarazu, bin receive di certificate from di Japanese govment naming Kisarazu di hometown of Nigerians.

"Di four cities go foster foundation for two-way exchanges for manpower development wey go add value to di economic growth of Japan, Nigeria, and di oda three African nations.

"Local authorities hope say di designations go increase di population of dia cities, contributing to dia regional revitalisation efforts," di ministry tok.

About Kisarazu city?

Japan Salmon factory for Kisarazu

Wia dis foto come from, Getty Images/Tomohiro Ohsumi

Kisarazu na home to 136,000 pipo, and na only 70 kilometres away from di capital city of Tokyo.

E dey popular for fishing and farming and residents dey enjoy easy life for di city. For 2020, Nigeria Olympic team camp and train for di city.

Di city dey popular for seafood, and among dem na salmon and clams. You fit get oda Japanese cuisine like ramen, udon, takoyaki and taiyaki.

Di pipo of Kisarazu dey like to party like Nigerians and dem love education as dem dey also teach in English for dia schools.

You fit enta di city website for more information about medical, child support, transportation, among odas.